Saturday, July 26, 2025
Google search engine
HomeUncategorizedGhana vs South Africa highlights: Ghana beat South Africa for penalties to...

Ghana vs South Africa highlights: Ghana beat South Africa for penalties to win Wafcon 2024 third place


Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL FOOTBALL TEAM

Wetin we call dis foto, Ghana don repeat wetin dem do to South Africa in 2016 when dem beat dem to win bronze for di Wafcon

Di Black Queens don beat South Africa to win bronze for di Wafon 2024.

Dis na afta dem sama di Banyana Banyana 4-3 for penalties afta di game end 1-1.

Na di Black Queens wey get di beta chances for di first half and di second half but dem neva fit take dia chances – Doris Boaduwaa and Evelyn Badu togeda wit Princella Adubea don miss all di chances for di black queens.

Goalkeeper Cynthia Konlan gift South Africa di opening goal afta she fail to clear one backpass.

Na so Mthandi score for open net.

Ghana bin try to equalize but dem continue to waste di chances bifor Chantelle Hlorkah cross one ball for di head of Alice Kusi.

Di ball beat di South Africa keeper Andile Dlamini bifor one defender try to clear am away.

Di ball still cross di line for goal 1-1.

For di final minutes for dat game, Ghana bin create more chances including di last kick for di regulation time.

Substitute Evelyn Badu collect di ball, she beat everibody wey she enta di box, but her shot hit di cross bar.

Dat na di third time ghana bin hit di bar for di Wafcon.

But afta di penalty shootout, na Ghana bin win 4-3. Cynthia Konlan bin save two kicks, wey Andile Dlamini also bin save one kick.

Ghana wit dis result don repeat wetin dem do for 2016 when dem beat South AFRICA 1-0 to win bronze for dat edition of di Wafcon.

Alice Kusi wey be player of di match tok say she don happy say her team fit win di medal for di whole kontri.

“Na tough match we don play, but we bin get hope bifor di match say we go beat dem and repeat wetin we do for 2016, we tank God say we fit do am.”

“Dis na medal for di whole team and di fans,” Alice wey be di top scorer for Ghana (2 goals) tok afta di game.

scene from the game

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL TEAM

Wetin we call dis foto, goalkeeping error gift South Africa 1-0 lead for dis Bronze medal game

Penalty shootout

  • Ghana take dia kick Nancy Amoah score 4-3 to win di game for Ghana!
  • South Africa take dia kick Seoposenwe score 3-3
  • Ghana bin dey take di penalty again. Jennifer Cudjoe score 3-2
  • Ghana take dia kick Jennifer Cudjoe miss 2-2 (keeper save am)
  • South Africa take dia kick Linda Magaia miss 2-2 (keeper save am)
  • Ghana take dia kick Josephine Bonsu score 2-2
  • South Africa take dia kick Holweni save am 2-1
  • Ghana take dia kick Alice Kusi score 2-1
  • South Africa take dia kick Mbane score 2-0
  • Ghana don take dia kick Chantelle Hlorkah do miss am 1-0 (keeper save am)
  • South Africa take di first kick wey Mothlhalo don score 1-0

South Africa also bin win one penalty shootout v Senegal

Ghana don alreadi win one and lose one penalty shootout for dis tournament.

Now dem gat to determine winner for dis bronze game thru penalty shootout.

Evelyn Badu don make emotional afta dat shot bin hit di crossbar.

ghana v south africa

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S TEAM/BANYANA BANYANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ghana bin win di bronze medal v South Africa for di 2016 tournament

Second Half

Evelyn Badu neva understand how dat ball no enta di net.

Da chance fit win di game for di black queens bifor. Dat na di third tiem for dis tournament wia Ghana don hit di woodwork.

Chhhhaaance! Ghana don hit di crossbar! Evelyn Badu tink she bin score but her shit don hit di bar.

90+5″ Ghana try to create sometin but di attack don turn for South Africa wey bin attack.

90+4″ Alice Kusi try to enta di South Africa box but she don lose di ball

90+3″ South Africa don win freekick inside dia own area, dem take am quick. Afta dem win throw-in bifor Linda Motlhalo shoot on target but keeper Konlan catch am

90+2″ Chaance! Alice Kusi try to shoot from distance but di ball go wide.

Dem bin add six minutes to di game to see who go fit score di winner.

90″ Chance for Ghana as Adubea enta di box and try to score but di ball go wide.

Di game don turn end-to-end action, bot teams wan score di late goal.

89″ Ghana bin dey try to create sometin but Asantewaa im long pass into di South Africa box dey too long.

88″ Ghana don clear one ball inside dia area afta South Africa try tyo attack.

Time now dey go for dis two teams, na penalty shootout wey go decode dis one if nobody fit score.

86″ Ghana coach bin dey vex for di touchline as im dey ask why ref don blow whistle for throw-in when di ball no comot. Ref now give am warning.

85″ Donelly try to get involve alreadi for dis game but she don foul Ghana captain Portia Boakye.

83″ Dem bin change Noxolo Cesane for South Africa wia Donelly don enta, na so Ghana also bin change Susan Duah wey don hurt.

82″ Bongeka Gamede don hit di frekick. Dangerous ball she don hit into di area Mbane now use her leg hit di ball wide. Chance for South Africa.

Di South Africa player bin dey for ground to receive treatment.

80″ Yellow card to Ghana captain Portia Boakye as she don foul her attacker. She gat to be careful for di rest of di game.

79″ Di Banya Banyana don take di corner but goalkeeper Cynthia Konlan don catch di ball.

scene from the game

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, South Africa beat Ghana 2-0 for dia Group C opener for dis tournament

78″ Offside against Magaia from South Africa.

77″ South Africa bin dey wan penalty afta Seoposenwa try enta di box to shoot wey she fall down, ref wave play on.

Ghana bin dey pepper di South Africa area for di last few minutes, Adubea bin get anoda chance to head di ball but e don go ova.

75″ Adubea don shoot wide as she don dey fall for ground, di ball pass di side of di post wey e don comot. Good chance!

74″ Ghana captain Portia Boakye tink say she collect one ball bifor dem foul her, as she don dey stand up na so Cesane drag am for floor. Ref bin tok to di two players but im no show any yellow card.

73″ Ghana try to attack for di far side, di player try to dribble plenty bifor di chance don scata. Goalkick

72″ From di corner South Africa bin dey hold di ball inside di Ghana area but dem neva fit penetrate yet

Powerful freekick from Jane bifor e don hit di Ghana wall for corner.

70″ Freekick for one dangerous position for South Africa afta Susan Duah don foul her attacker.

67″ GOOOAL! Ghana bin equalize thru Alice Kusi. Fine cross from Chantelle Hlorkah wey Alice Kusi don head di ball into di goal. Di keeper Dlamini use her hand touch di ball bifor di defender try to clear di ball but e don alreadi enta. 1-1

66″ South Africa try to build one attack but Ghana bin clear. Throw-in to South Africa.

Chance! From di corner, Evelyn Badu don connect wit di cross but her header go wide.

64″ Corner to Ghana. Adubea bin win dat one too. So far she bin dey pepper di South Africa defence na di end product wey remain.

62″ Portia Boakye from Ghana don defend one ball well well as di South Africa attacker bin dey put pressure for her top. Yellow card for di South African afta she kick di ball away.

61″ Princella Adubea don dash possession in front of di South Africa area.

58″ Ghana try to create sometin but di ball end when anoda two players don come togeda. Chantelle don use her knee to tackle Lebohang Ramalepe. Yellow card for Chantelle.

Ghana don improve but dia finishing still bin dey poor so far.

56″ Ghana defender Comfort Yeboah bin dey for ground afta one foul for Nexolo Cesane inside di midfield. Comfort bin dey ground dey receive treatment.

55″ Chaaaaance! Ghana try to equalize wit dat one. Evelyn Badu head one cross on target but di ball go ova di bar. close!

54″ South Africa no clear di ball from di corner, wey di ball fall for Chantelle she hold di ball and dribble bifor she win anoda corner.

53″ Corner to black queens! Di sub Princella Adubea again bin put pressure on top di defender to win di corner.

52″ Freekick to Ghana. Portia Boakye bin play am short, Ghana win throw-in from dat attack bifor dem dash di ball to South Africa.

51″ Anoda chance for Ghana. Dis time Adubea don overrun di ball inside di box as she try to cross to her teammate. Goalkick.

50″ Chance! Princella Adubea enta di box wey she try to reach one ball but she bin foul her marker. Ref blow for foul.

Ghana dash di ball to Ramalepe as dem try to pass di ball to create some pressure. Throw-in to South Africa.

48″ Di two Ghana subs bin dey press di South Africa defence well well.

Evelyn Badu try to hustle di ball from di South Africa defender but di ball comot fro throw-in.

47″ Ghana already bin dey struggle to keep possession.

South Africa already attack di Ghana area wit di substitute Jane, she bin enta di box wey she shoot one for di Ghana goal but Konlan save am.

46″ Ref whistle to start di second half wit South Africa.

Ghana also bin make two changes. Evelyn Badu and Princella Adubea don enta di match.

South Africa don make one change to start di second half. Di goal scorer Nonhlanhla Mthandi comot di game.

Ghana coach Kim Lars go vex about dat gift wey im keeper don dash to South Africa afta dem play well dis first half. Di black queens fit to turn dis around? Na time go tell.

black queens

Wia dis foto come from, GHANA NATIONAL WOMEN’S TEAM

Wetin we call dis foto, Ghana coach say im team don dey reach elite level to compete wit any team for di world

First Half

Ref don end di first half afta dat action. So far Ghana na di better team wit seven shots but South Africa wey get di advantage as dem take di chance afta Ghana keeper Cynthia Konlan make ogbonge mistake for di back.

45+2 Ghana try one more time to hit di target. Chantelle Hlorkah hit one from near di centre towards di goal – di ball go wide, but ref whistle for offside serf.

45″ Alice Kusi bin dey try all her best for di left hand side of South AFrica but di fibal ball for dat occasion go out for throw-in.

43″ GOOOAL! Ghana keeper Cyntia Konlan don gift South Africa one goal out of nothing. Di Ghana keeper instead say she go clear di ball try to dribble for di back wey South Africa pounce to score into an empty net!

42″ Anoda poor cross by Ghana.

41″ Di game don dey enta halftime wit both teams without goal for dis bronze medal match.

40″ Ghana don get anoda chance to attack di Banyana Banyana backline but di player cross one weak ball into di box wia keeper Dlamini don collect, wasted!

39″ Hilda Magaia shoot one from distance for di Ghana goal but soft work for Cynthia Konlan.

Goalkeeper Cynthia Konlan don feel di presure from Jermaine Seoposenwa as she bin try to reach one ball in front of her. Afta treatment, she don stand up for di game to continue.

Ghana try to play di long ball for Chantelle Boye-Hlorkah wey bin dey run into di South Africa area but keeper Dlamini comot wey she come boot di ball away.

36″ Ghana don make mistake for dia defence wey South Africa collect di ball but dem no fit take advantage.

35″ Anoda low cross from di right hand side of di Ghana area by Comfort Yeboah into di box – na easy catch for Andile Dlamini.

Freekick to South Africa afta Comfort Yeboah foul Noxolo Cesane for di South Africa area.

32″ Di game don restart wey South Africa try to build again from di back but dem dash di ball to Ghana again. Di shot from di left side of di South Africa area don enta goalkeepr Dlamini im hands.

Ghana bin get di best chances for dis game so far, but dem neva take any of dem. Di game still be 0-0.

29″ Jennifer Cudjoe don win one ball for midfield from Linda Motlhalo wey she pass di ball forward. Motlhalo bin sit for ground as Ghana continue to play. Las las ref come back to check on her.

28″ Ghana get corner wey dem take am quick quick but South Africa clear di aeriel ball wia ref whistle for foul against Ghana.

27″ Grace Asantewaa bin dey dominate di midfield so far for dis game wey she dey win all di balls.

26″ Ghana create one fine chance as dem pass di ball into di South Africa box, na so Stella Nyamekye try to shoot but dem block her shot. Grace Asantewaa bin shoot di follow up but goalkeeper Andile Dlamini don save di ball.

25″ Ramalepe bin try to hold di ball and put one pass ova di top to her teammate but di ball don go to her opponent.

23″ Freekick to Ghana for midfield afta Lebohang Ramalepe don foul Stella Nyamekeye as Ghana bin try to counter.

ghana coach and chantelle

Wia dis foto come from, GHANA NATIONAL WOMEN’S FOOTBALL TEAM

Wetin we call dis foto, “If we bin dey play for top four consistently, we go finally win di tournament one day”

22″ Chance for Ghana! Alice Kusi im header from di corner from Portia Boakye go wide.

21″ Corner to Ghana! Boaduwaa bin hold up di ball well as she bin dey wait for support inside di South Africa box, but no player dey inside di box, na so she win corner for di black stars.

20″ South Africa try to attack Ghana for di far left hand side wia dem cross di ball straight for di hand of goalkeeper Cynthia Konlan.

19″ South Africa bin dey clear all di cross into dia area. Ghana striker Boaduwaa don waste anoda chance, wey she fall for ground in front of di South Africa box, she dey want freekick but ref say play on.

18″ Ghana now dey keep di ball for dia area wit passes, bifor dem release di ball to midfield. Throw-in to Ghana for di near side of di South Africa area.

16″ Ghana captain Portia Boakye bin sit for ground afta Hilda Magaia bin use elbow scratch her face, but ref say e neva be foul. Game on!

15″ Offside! South Africa tink say dem beat di Ghana defence for one attack afta dat Boaduwaa wasted chance but ref whistle for offside.

14″ Chaaaaance! What a chance! Alice Kusi bin create one ogbonge chance wit a cross into di six yard box, na so Doris Boaduwaa shoot di ball ova di bar.

13″ Stella Nyamekye don foul Bongeka Gamede wey ref don whistle for infringement.

Ghana captain Portia Boakye play di freekick but na waste. E don over everibodi wey e comot di park. Wasted!

12″Freekick to Ghana afta Nonhlanla Mthandi bin foul Grace Asantewaa close to di centre circle.

11″ Banyana Banyana defender Bongeka Gamede don use style dribble di Ghana striker Doris Boaduwaa as she bin dey put pressure on di South Africa defence.

9″ South Africa try to build from di back wit dia keeper Dlamini before

8″ Di South africa defence don concede fewer goals compared to dia Ghana counterparts for dis competition. Dem alreadi begin to show dia defensive quality for dis game.

Goal keeper Andile Dlamini neva even move from her area for dat cross by Kusi.

6″ Kusi don fire one cross ova di bar from inisde di box, she wan make dem gove her corner but ref say na goalkick.

Offside! South Africa don dey offside. Ghana begin di pass from di back.

4″ Tins don dey calm down now, but still South Africa bin get di upper hand so far.

2″ From di corner Ghana don clear di ball to relief di pressure.

Di Banyana Banyana don mean dis game early. Ghana bin dey under pressure

1″ Afta di kick off, South Africa push to get quick goal but Ghana keeper save am, corner to South Africa!

Referee don blow whistle to start di game.

But we go find di winner afta dis game whether for regulation time of penalties. Time go tell

Both coaches tok say to win medal for di competition go be consolation for di players and di fans.

Both teams don comot for park – Ghana don dey wear dia yellow jersey wey South Africa bin dey wear dia traditional green jersey jersey

Welcome to di bronze medal game for dis Wafcon 2024 between Ghana and South Africa for di stade Larbi Zaouli for Cassablanca.

Coach DR Desiree Ellis

Wia dis foto come from, BANYANA BANYANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Coach Desiree say “we wan go home wit sometin not just for Salgado and Jermaine, but for di fans and di pipo of South Africa.”

Ghana XI: Cynthia Konlan (GK); Susan Duah, Comfort Yeboah, Grace Asantewaa, Jennifer Cudjoe, chantelle Boye-Hlorkah, Doris Boaduwaa, Alice Kusi, Stella Nyamekye, Portia Boakye ©, Josephine Bonsu

South Africa XI: Andile Dlamini (GK); Lebohang Ramalepe ©, Bongeka Gamede, Regina Mogolola, Noxolo Cesane, Hildah Magaia, Linda Motlhalo, Jermaine Seoposenwe, Bambanani Mbane, Nonhlanla Mthandi, Sibulele Holweni

south africa team

Wia dis foto come from, BANYANA BANYANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di South Africans wan use dis game as tribute for Salgado and Jermaine



Source link

RELATED ARTICLES

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

- Advertisment -
Google search engine

Most Popular

Recent Comments